If You Like Give Up - 3wks ago

Image Credit: Don't give up

Meet Igor Thiago di 24-year old Brentford player wey dey use goals sew clothes for opponents currently.

If person tell Igor Thiago say e go later dey this stage e no believe because e bin no get hope and e get stage wey e reach wey e nearly quit football.

No work wey Igor never do because hin papa kpai when e still dey small, e don do bricklayer work, share flyers for road even if you pay am make e come cry for bur!al di bobo dey active as long as m0ney go come out.

Now look at him now, e don score 17 goals in 22 games for Brentford this season come still dey collect over £50k( over 95 m!llion naira) every week for Brentford.

If you like lose hope na you sabi…

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message