Some people dey suprise because dem hear say dem don call up Thiago Silva son to England U-15 national team.
• Wetin dey suprise some people na because Silva and hin wife na Brazilians and dem born di pikin for Brazil too so dem dey wonder how e take dey eligble to represent England, Oya make I explain.
• Di Silva pikin wey dem call for England U-15 na Iago Silva and e dey represent England through residency rules.
• Di rule say, if di person dey below 1-10 years and e don live for di country for atleast three years, di person di eligble to represent di country.
• If di person dey below 10-18 and e don live for the country for atleast 5 years di person fit represent.
• So for Silva pikin matter, hin pikin don dey live for England since 2020 and e come when e never reach 10 years na why e dey eligble.
But if e won play for senior national team e go need British Passport if not e no go play senior team.
Silva pikin fit still play for Brazil in future if e no play three senior competitive games for England.