I no know when this our Nigerian boys go dey hear word, at this stage wey Daniel Daga dey hin name and anything wey relate to e knack person without her consent ( asin r•pe ) no suppose dey move for di same place.
Pikin wey play my Enyimba on loan, then move to Molde FK for Norway in January 2025, e never play reach 5 months in Norway naso one girl go report to police say Daniel Daga enter her local government area without her approval.
Na yesterday di Nordmøre and Romsdal District Court say Daniel dey guilty dem come sentence am to 6 months in prison still tell am to pay fine, even hin club don suspend am till further notice.
Now Daniel dey tok say him and di girl agree before dem knack so e go appeal di judgement.
I pray make e win di appeal, but my own be say 19-year old player wey go look for hin daily bread for abroad no suppose dey get konji, even if your pr!ck Stand you go use ice block bring am down till you enter Naija.
Naso dem take spoil Akinkunmi Amoo career and na very talented winger.