Morocco Ehhhhhhhnnn - 2wks ago

Image Credit: This final go long ooo

Breakfast go reach everybodi for this 2025 AFCON, e don reach Senegal dem don dey cry.

• Senegal FA don cry come out say di way Morocco people take dey treat dem ahead of this final no good at all.

1) Dem say Morocco FA no give dem security as dem reach Rabat station wey expose di team to risk.

2) Dem say na protest Senegal FA do before dem gree give dem 5 star hotel, dem bin won put dem for those hotel wey dem dey on AC by 11pm off am by 1am.

3) Dem say Morocco people no allow dem train for Mohammed VI Complex training ground and till now dem never see where to train.

4) Dem say na only 2 vip tickets Morocco people allocate for dem say dem no even allow dem buy VIP tickets and VVIP tickets.

5) Senegal FA say although dem later buy tickets for their supporters but di tickets wey dem fit buy na just 2,850 tickets for stadium wey get over 53 thousand seats.

Chai, Chai, ontop small AFCON final ooo, make we kuku leave di competition for Morocco make dem chop am.

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message