CRY OF THE PEOPLE(PART 1) - 1 year ago

Image Credit: Mildred

 [ Set in the marketplace]

Characters:

Mama Osaro

Politician

Aboki

Madam Joy

Osaro

Mama Osaro:[at her table with an umbrella, calls out her son] Osaro, Osaro! Where this pikin go, person wen dey here just now. Osaro!!

Madam Joy: [walks up to mama Osaro] Mama Osaro, good afternoon. How market?

Mama Osaro: Market dey fine o.

Madam Joy: I want to buy meat, how much is this one?( Points to a piece of meat on the table)

Mama Osaro: This one na #7000.

Madam Joy:(exclaims) For this small meat, mama Osaro it's too expensive.

Mama Osaro: madam Joy you know my things dey cheap. Na how things be now o, where we for dey buy meat don carry money join the meat.

Madam Joy: Wow, things are getting out of hand. Mama Osaro how you wan do me now. I brought just #5000 for meat.

Mama Osaro: Madam Joy nor worry I go sell for you better me.( Pick a piece of meat and is about to slice it)

Madam Joy: Mama Osaro, this meat nor fresh o. See the color.( Points to the meat)

Mama Osaro: Madam Joy, this meat na fresh one na just light mi nor dey, na make the meat change color. You know say I nor go sell wetin bad for you as you be my correct customer.

Madam Joy: So you mean there is no light in this big market?

Mama Osaro: (laughs) for this market, we nor dey see light o. Light people dey use us dey enrich themselves. Like now as we nor get light, them dey bring bill for us o. Them fit even just bring light for one hour if them wan go come collect money. As them comot from the market, them go just off am.

Madam Joy: These people are very wicked.(angrily) later we will hear on the news about how there is steady supply of electricity. What are our taxes doing in this country, absolutely nothing.

Mama Osaro: The tax sef na another thing. If you hear how much I dey pay for this shed on top this small meat mi I dey sell to train my children,you nor go believe.

Madam Joy: you don't mean it. Things need to change in this place o.

[ Soon a political group starts passing]

Political group: IPP, Improve the people party!!!( Chants this together on a spot)

Politician: People for this market, I greet una o. Time to come again, your son don come out to represent the people as una Local government chairman. I come say make I tell una make una vote for. I get a very important agenda for the market, to help our market and people lives beta.

Supporter: Yes o

Politician: Yes, I don hear about all the things wen dey happen, all the suffer and I assure una say after una vote me, this market wen nor get light go get light( supporters hail Him), not just any light o. I go put solar for this market. All these bad roads I go bring technology from abroad take repair all these roads wen for years to come them nor go spoil. Our health center go change, I go build better health center, clean water for even house for this place. My name still remain Comrade Austin. So abeg my people vote for me, una nor go regret.

Political group: IPP, Improve the people party!! Vote for comrade Austin the right choice.

Mama Osaro: You nor see all these people don come again with their lies, na small remain make e promise us mini sun for inside our house. Them go just come, talk all this plenty talk, later we nor go see anything. Madam Joy  I don wrap your meat.

Madam Joy: Thank you, mama Osaro. Where is your son? I have not seen him, how is he?

Mama Osaro: He dey fine, e even follow me come market but I nor know where ehe don run go now.

Aboki: mama Osaro, mama Osaro( runs to her out of breath).

Mama Osaro: Aboki wetin happen, something dey pursue you?

Aboki: your pikin(points to the road)

Mama Osaro: wetin happen?

Aboki: motor, motor jam am just now for road o.

Mama Osaro: you say( ties her wrapper in shock) talk am again, my Osaro??!!

Aboki: them rush am go health center, na nurse come say e don go.

Mama Osaro:( panicking) go where?

Aboki: e don go, say e nor de breathe again.

Mama Osaro:( falls to the floor , screaming and crying) Aboki, na lie you talk , my Osaro??

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message