Algerians no gree accept defeat because di whole thing be dem like film.😂
Dem no see who dem go blame na referee dem come dey hold, shey na referee tell Nigeria make dem no allow una play shot on target?
Shey na referee tell Nwabali make e work from home yesterday?
Dem say we pay referee , how we wey never pay players finish go come dey pay referee?
Even if we play this match again Algeria go still lose because we dey active everywhere while una pack unaselves full middle.
Oya una dey vex because of hand ball same referee commot my goal wey cross line so I go add una penalty una go add my goal wey nearly tear net( FT Scores Algeria 1 - 3 Nigeria )😂😂😂😂
Abeg @CAF which time Algeria plane go leave Morocco i won make dem help me buy Okpa for road😂