E Sure Me Say Una Morning Good , I Don't Need To Say Good Morning Fams - 2wks ago

Image Credit: Senegal Vs Morocco final

The truth be say Morocco people think say dem wise but dem no wise at all.đŸ¤£

Na Nigeria match cast dem well wey make Senegal calm down prepare for wAr.

If to say Morocco no show their formats against Nigeria wey be semi final ooo, Senegal for no know Morocco plans.

• Against Nigeria, dem dey send people make dem commot Nwabali towel, e reach Senegal turn naso Senegal carry person put near post make e dey guide Mendy towel and di guy dey active oo.đŸ¤£

• Dem rush buy all di tickets for Semi final same formats wey dem suppose keep for final dem come expose am wey make Senegal players come calm down learn how to play under noise( ebi like na speaker dem use do training)đŸ¤£

• Nigeria dey tolerate referee decision, e reach Senegal turn dem leave pitch for referee make e play with Morocco players, na beg dem beg Senegal players before dem gree come back.

• Even as dem suspend di match Morocco fans think say dem go intimidate di small Senegal fans wey dey stadium naso chairs begin fly aound.đŸ¤£

Morocco no expect amđŸ¤£

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message