Because today na Thursday make I throw una back to 2008 when one referee lose im job just because of ogogoro.
Sergey Shmolik na beta referee for Belarus premier league, and na FIFA listed coach wey start e referee career from 1993-2008 wey dem ban am because of ogogoro, Sergey even collect best referee award in 2007 for Belarus league.
In 2008, dem call Sergey Shmolik make e come officiate Vitebsk and Naftan match for Belarusian Premier League, as baba enter pitch, e first stand for middle of the pitch come bend down small like say back the pain am, as e bend down e come close e eyes blow whistle, naso players start match.
Sergey Shmolik dey blow whistle every secs, if player won score e go blow whistle people come dey suspect say referee don dey on c0los but the one wey shock dem na when oga Sergey Shmolik come stand for centre of the pitch dey officiate match e no gree run again.
As people don dey notice say that referee no well naso dem send one referee official make e carry that man commot before e go kpai for pitch, as dem carry am commot, dey ask am wetin dey worry am baba say e dey sick say back the pain.
The order bus carry am go hospital come tell doctor make e do test, as doctor do test finish, doctor tell the officials say ogogoro wey dey for that referee body too much, say if dem commot e don reach to open one ogogoro company na why e dey behave like that, baba drink beta ogogoro come pitch.🤦
Na for that hospital dem write e sack letter, dem ban am for that league say make e no officiate any match again.
My people as dem ban am for life e good?🙆