Happy birthday to Rogério Ceni di goal-keeper wey get goals pass some strikers.
Rogério Ceni na former Sâo Paulo player and current Bahia coach.
Baba bin score 131 career goals as a goalkeeper and inside that 131 goals, 69 na penalties, 61 goals na Free kick while 1 na open play goal.
Di goals make am hold di Guinness record for di most goals scored by a goalkeeper.
No be only goal Rogério Ceni sabi score di baba sabi keep ball too.
Brazil get talent oo, abeg make una wish baba well oo e don enter 53 today.