I Am Impressed - 3wks ago

Image Credit: I am impressed

FT Scores: Algeria 0 - 2 Nigeria

I tell una abi I no telll una ?, our strength is too much !!!!!!!!

My people, Super Eagles don finish their training ahead of their semi final game against Morocco and people wey we use do training na one country like that wey dem dey call Algeria.

Before match start, some people just dey make mouth say na luck Nigeria dey use win say Algeria go do this one Algeria go do that one but as match start Algeria no see ball play, even shot dem no see play soety i come dey regret why we use goalkeeper against them.

I play Algeria soety dem no believe am, till now dem still dey f!ght for pitch dey ask our coach wey e use this kind dangerous tactics from Abagana.

My people, I feel like crying for Morocco because even if dem no run today dem no fit escape their own bEating!!

How una see this match ?

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message