Make i give una one gist. I get one big man friend, Taiwo. See ehh, this guy dey on that money na water level, walahi. But e dey fear love die, e problem na say woman fit love am only because of wetin dey him account, not for who him be.
So e gt this fine girl, Teni, fine girl wey fit make pastor start to speak in tongues. Her beauty no get competition, but her eye dey shine anytime she hear money.
I no say Taiwo like this girl die but he no wan make the girl know say e guide wella. Taiwo con dey hide him wealth, dey waka like ordinary guy wey dey hustle. First date, him carry her go buka, she squeeze face like say her phone spoil 🤣🤣🤣
“Na here you wan make person chop?” no be small hiss every now and then. “I no dey suffer with man o. I sabi my worth.” na wetin she tell Taiwo o 🤣(women sha, na wa)
Taiwo smile small. “No worry, better days go come.”
Weeks pass, so tey e reach one month, Taiwo still dey pretend, Teni just tire. She begin complain say she no fit dey with man wey no fit buy am small iPhone, talk less of wig.
One evening like that, as harmattan breeze dey blow, wey all of us just dey one side dey chill, Teni just begin cut chain o (as in Para) she talk am straight “I no fit continue. Love no be food. Rich man go see me somewhere, abeg enjoy your life.”
Na so She waka comot.
Later that year, she con jam Taiwo again, this time, my guy dey inside one sharp Prado like this o, security dey follow, suit sharp like new razor. Her mouth just open wide, like gate wey don spoil.
“Taiwo?!” Omo she wan rush hug am o.
Taiwo look am soft, but pain dey hide for him eyes. Taiwo be like this girl sha.
“I ask you that time, say make you dey with me, You show me say your love get price.”
She wan talk, but words no gree come out. Omo my guy no waste time, e just drive comot, she just stand there like pikin who rain don beat scatter.
The thing with Taiwo na say him get money, but the only thing wey him no fit buy, na loyalty. Most Nigerian girls no dey reason life like that again o.
Love no be for mouth; na who go dey with you when wallet empty, be the real one.
How Burna boy take sing that song again...ehen, 🎼 na who love me i go love, na who like me, i go like 🎼