See Wetin Dey Cup For Country Wey Go Follow Host World Cup - 3 days ago

Image Credit: Mexico

You see all these players wey dey run here ?

No be say dem dey run because first half finish oo, or dem dey run make dem go drink water?

You know why dem dey run? dem dey run for their l!ves.

Di thing bin happen during Necaxa W vs Queretaro match this early morning and wetin happen be say some cartels bin dey sh00t g•n anyhow.

Di name of di cartels na Jalisco new generation cartel and dem dey vex because dem don kpai their oga El Mencho.

Government bin tok say anybody wey help give information to catch El Mencho say dem go give di person $15m( over 20 billion naira) because di man and boys dey carry dr•gs and some other things.

Since dem kpai di man, hin boys just dey b•rn anything dey block road.

Well, dem don postpone some football matches for Mexico, no forget say Mexico go follow host Worldcup sha..

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message