About Ex Wey Know Gree Move On - 15 hours ago

Image Credit: Move on

Ex wey no gree move don finally reach court..

My people, Andy Carrol bin go court today because say e dey call hin ex wife for phone.

Wetin bappen be say, Andy Carrol and Billi Mucklow bin marry in 2022 come break up in 2024 and dem get one child together(although Carrol get two before).

As dem breakup, family court come tell Andy Carrol make e no dey call hin ex again( court give non moleEstation order ).

But even as court give di order finish, Carrol come still dey call hin ex for phone dey worry her according to di lady, and na non reasonable things e dey call dey tell am.

As Carrol reach court today, court release am, adjourn di case to 4th March 2026, court still give am one condition say make e no try call hin ex wife again say if e call or even do mistake flash her say dem go arrest am put am for kirikiri till this case finish.

My people make una pray for una brother make e no do mistake call hin ex again.🙆🏿‍♀️

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message