Because today na Thursday make I throw una back to 2021 when one footballer do wetin suprise people just because e won commot for di club š
Di name of di player na Didier Lamkel Ze and wetin happen be say di bobo bin won join one Greek club wey dem dey call Panathinaikos but Royal Antwerp wey be hin club no gree because dem no agree to di terms of di transfer.
Di bobo don agree personal terms but Royal Antwerp no gree naso di bobo use vex wear Anderlecht jersey come training di next day but security no gree am enter because Anderlecht and Antwerp na rival e just be like where Mainoo wear Man City jersey come training or Neto wear Arsenal jersey come training.š
Omo security no allow di bobo enter oo, dem pursue am commot for di place and di bobo later reach house come dey apologize to Royal Antwerp fans.
Las las e no later go di Greece , Royal Antwerp send am go loan for Slovakia.
My people abeg wetin di bobo do e good?