The Day I Nearly Turn Superstar - 9 months ago

One hot afternoon like dis, I say make I go market go buy small things. As I dey waka go house, breeze just begin show him power. Before I fit blink eye, gbam! My wig don fly comot for my head like say e dey run from landlord. ๐Ÿ˜ญ

Before I fit shout โ€œJesus!โ€, the wig don land for road, one small pikin sharp like razor just pick am begin run. I shout, โ€œCome back here! Na my hair you carry oh!โ€ 

I no gree shame me, I pursue the boy with full energy. People for street begin laugh, one man even shout,

โ€œMadam, na breeze thief your beauty oh!โ€, another person said โ€œMadam, no vex! E no know say na human hair!โ€

I finally catch am, collect my wig back, wear am anyhow. Na that time I realize say I don wear am back to front,  fringe don turn moustache. ๐Ÿ˜‚

One woman look me say,
โ€œMadam, even your hair confuse pass Nigeria economy.โ€

Since that day, I swear, if breeze carry my wig again, make e go start new life. I no get strength to dey chase hair wey no wan stay loyal. ๐Ÿ˜…

 

 

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message