One hot afternoon like dis, I say make I go market go buy small things. As I dey waka go house, breeze just begin show him power. Before I fit blink eye, gbam! My wig don fly comot for my head like say e dey run from landlord. 😭
Before I fit shout “Jesus!”, the wig don land for road, one small pikin sharp like razor just pick am begin run. I shout, “Come back here! Na my hair you carry oh!”
I no gree shame me, I pursue the boy with full energy. People for street begin laugh, one man even shout,
“Madam, na breeze thief your beauty oh!”, another person said “Madam, no vex! E no know say na human hair!”
I finally catch am, collect my wig back, wear am anyhow. Na that time I realize say I don wear am back to front, fringe don turn moustache. 😂
One woman look me say,
“Madam, even your hair confuse pass Nigeria economy.”
Since that day, I swear, if breeze carry my wig again, make e go start new life. I no get strength to dey chase hair wey no wan stay loyal. 😅