Afcon 2025 Full Fixtures, Results, Scores, And Group Standings - 1 month ago

Di Africa Cup of Nations (Afcon) dey happun between 21 December 2025 and 18 January 2026 for Morocco.

Morocco carry go dey under ogbonge pressure enta di opening game as di hosts, wit dia star player Achraf Hakimi wey dey return from injury.

Senegal, di reigning champions Ivory Coast, Mohamed Salah Egypt and a Nigeria side led by Victor Osimhen dey among di biggest rivals for Morocco for di Afcon.

Di 2025 edition bin suppose be mid-year tournament, to allow make e for no clash wit European clubs and competitions.

Di summer event suppose boost tourism and highlight wetin Morocco get to offer, before di kontri co-hosts di 2030 World Cup wit Spain and Portugal.

But dem shift am to December to make way for Fifa expanded Club World Cup, wey dey hold for summer.

Di move to a start in December rather dan January go avoid conflicts wit di Champions League and Europa League, wey go restart on 20 and 22 January respectively.

Dis go be di first time Afcon go hold for dis time of di year wit matches dem go play for Rabat, Casablanca, Marrakech, Agadir, Tangier and Fez.

Make you engage wit di graphic below to see di group tables and fixtures. Di match results go dey update  automatically once di matches end.

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message