Which Kind Club Be This My People - 5 hours ago

Image Credit: Brazilian club

This club wey you dey see so na one Brazilian club wey dem dey call Associação Desportiva Vasco da Gama.

• This their goal keeper name na Bruno Fernandes de Souza, many people go remember when I post hin tori here.

• Incase you no know, back in 2013 dem sentence this goalkeeper to 22 years in prison because e give w0man belle come tell di girl make e commot am di girl no gree naso Baba lure her enter bush kpai her still pieces her bodi.

• Na why people dey suprise say dem see am for match yesterday.

• That player wey wear number 22 for this club sef dey face hin own court case, dem allege say e r•pe w0man.

Infact, Erick Luiz Serpa, Matheus Silva, Brian Peixoto, and follow for di case and all of dem still dey play match for di club.

My people which kind club be this one?

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message