How I Almost Fell Down On Okada Last Month 😂 - 2wks ago

Last month ehn, I wan use sense save money… but na small thing remain make I use my life balance am 😭

I get one urgent delivery to do. Client don dey call me like say I be dispatch rider.

“Hello, where are you?” “Almost there ma…” meanwhile I never even leave house 💀

I check Uber price… I nearly cry. ₦7,500 for where I dey go?? For this Tinubu economy?? God abeg.

I just hiss, carry my bag comot.

“Okada! Okada!”

One guy stop. Him face no too friendly but at that point, time no allow me reason am.

“Bros, how much to go Lekki Phase 1?” He tell me price wey still pain me small, but I say okay.

As I climb, I don already dey calculate: “If I deliver this thing sharp sharp, I fit still use the balance chop shawarma” 😌

But I no know say na trailer of Final Destination I just enter.

We never reach 2 minutes, I don dey shout: “Bros abeg, make we dey go fast small, I dey late!”

Na there wahala start.

This man no talk. He just nod… then VROOOOM! 😭

I first think say na normal speed increase.

Next thing, we don enter traffic like Fast & Furious audition.

Cars full everywhere. Instead make him slow down, this man dey squeeze inside small small space wey even mosquito no suppose pass.

Me: “Jesus… okay… Jesus… okay…” 😭

One keke just shift small, na so my okada man enter that gap like say him life depend on am.

I hold the bike like say na my village land.

“Bros… bros abeg oh… no kill me before I deliver this product oh!”

He no answer.

Next thing, one man just cross road without looking.

GUYYYYYY 😭😭

My okada man brake like say him leg na iron.

SKRRRRRRR!!!

I swear my soul comot my body come back.

I lean forward, almost land for the man back. My leg sef don shift—na God hold me.

The pedestrian just look us like: “Una dey mad??”

Me sef wan ask.

I just shout: “BROS STOP!!! I no dey go again 😭”

He finally stop one side.

I come down with shaky legs like person wey just escape accident movie.

I just dey laugh… that kind laugh wey no be joy. Fear dey inside.

I tell am: “Abeg take your money, I go trek. Even if I late, at least I go still dey alive explain myself.”

As I dey walk go, I just dey think: “All this because I wan save money??”

Las las, I still late.

Client vex small… but at least I no go tell am say:

“Sorry ma, I for deliver earlier but I almost kpai on top okada.” 😭😂

Moral of the story:

If your spirit no agree with okada speed… no force am.

Because delivery fit wait… but your life no get duplicate 😭

You don ever experience okada driver wey think say him be stuntman? 😂

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message