Hunger wan kpai everybody.
Poverty don rubbish everybody.
Inside Abuja, placards dey our head
Inside Kano, we dey shout make dem hear
Shey e never reach make
oga Presido show us face?
E be like werey dey body o
Wetin be dis? I say wetin be dis?
On a steady, leaders dey chop semo o.
Since January we no fe buy Zobo
Because Naira dey dobale for Dollar.
Naira na werey wey no sabi the suffer
Suffer wey we dey suffer
before one K go gum our body.
Garri don dey glow, dey turn to Gold
Fuel price dey grow, dey glow like Sisi.
Tuition fees dey buga, dey buga like yeast.
Rice price dey rise, dey rise like penis.
Oloun, hunger wan kpai us.
Walahi, poverty don rubbish us.
Inside Abuja, placards dey our head
Inside Kano, we dey shout make dem hear
Shey e never reach make
oga Presido show us face?
E be like werey dey body o
Who be dis one? I say who be dis one?
We dey protest, you dey burn plaza.
You dey steal indomie, you dey break glass.
You dey steal desktop, you dey steal gas.
Senior man, wetin you dey do now?
You don turn our protest to Scam
Small time, people go say protest na haram.
Oga, carry your placard for head
Demand for justice—shout make dem hear
Even if dey no hear, we be gentleman
Na like this we suppose run am.